| Pidgin
POLITICS
1 minit wey yu go read
ICRC: 14,500 people still dey miss for north-east Nigeria sake of kata kata
New numbers from International Committee of di Red Cross (ICRC) show say more dan 17,000 people don register as missing for Nigeria.
ICRC: 14,500 people still dey miss for north-east Nigeria sake of kata kata
Di kata kata don displace plenty people

As di whole world dey mark International Day of di Disappeared, families for north-east Nigeria still dey suffer and dey confused becos dem no know where dia loved ones dey.

New numbers from International Committee of di Red Cross (ICRC) show say more dan 17,000 people don register as missing for Nigeria, and over 90 percent of di cases na becos of fighting and insurgency for North-East, plus banditry and mass kidnapping for North-West and North-Central regions.

From dis numbers, about 9,000 cases dey Borno State, 3,000 dey Adamawa, and 2,500 dey Yobe. So di total of missing people for di three North-East states be about 14,500.

Insurgency still be di main reason why people dey disappear for dat region, and e don leave thousands of families dey balance between hope and sorrow.

Behind dis numbers na parents, brothers, sisters and relatives wey don spend years searching for dia loved ones wey disappear during di worst time of Boko Haram insurgency.