| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Tinubu dey call for stronger global action against insecurity
Di President talk dis one for Abuja yesterday at di international conference on security wey Jama'atu Izalatil Bidiah wa Iqamatis Sunnah (JIBWIS Nigeria) organise.
Tinubu dey call for stronger global action against insecurity
Insecurity na big palava for Nigeria

President Bola Ahmed Tinubu don call for stronger cooperation both for inside Nigeria and internationally, so dem fit tackle di new security tins wey dey threaten Nigeria and oda parts of di world.

Im talk sey Nigeria dey face "multifaceted" security challenges wey need coordinated and sustainable responses from governments, international organisations, religious leaders, and oda stakeholders.

Di President talk dis one for Abuja yesterday at di international conference on security wey Jama'atu Izalatil Bidiah wa Iqamatis Sunnah (JIBWIS Nigeria) organise wit di Muslim World League of Saudi Arabia.

Di conference, wey get di theme: "Diversity and social peace: partnership for a promising future," bring togeda Muslim and Christian leaders, scholars, and representatives from Saudi Arabia and oda African countries.

Deputy Senate President Barau Jibrin represent am, and Tinubu talk sey im administration still dey committed to work wit oda countries and international organisations to build stable and secure Nigeria, while dey also contribute to global security.

"Working within di Committee of Nations, [di government] dey collaborate evry day to make sure sey security dey not only for our country but for di whole globe," im talk.

Im talk sey di conference dey important becos of di way security dey change, and becos authorities, religious leaders, and oda stakeholders need to examine di new threats wey dey face national and digital security.