| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Tinubu don order security pipo to fish out Kaduna killers
Di President call di attack barbaric and cowardly terror against innocent people wey no fit defend demsef.
Tinubu don  order security pipo to fish out Kaduna killers
Bola Tinubu

President Bola Tinubu of Nigeria don condemn di midnight attack wey kill at least 30 people, including eight pikin, for Naridon Village for Kaduna State.

Di attack happen on Sunday night.

Di President call di attack barbaric and cowardly terror against innocent people wey no fit defend demsef.

E don give order to di Armed Forces, police, and intelligence agencies to step up operations immediately to find di people wey do am.

Tinubu give dis order for statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, sign on Tuesday.

Di statement title be ‘President Tinubu Strongly Condemns Attack In Kauru Local Government Area Of Kaduna State.’

According to Onanuga, di President still send im condolences to di families wey lose people, Governor Uba Sani, and all di people of Kaduna State.

E reassure di state government and di communities wey di attack affect say di Federal Government dey with dem for dia grief.

E talk say, “I don direct di Armed Forces, police, and intelligence agencies to increase dia operations for di affected areas so dem go quickly find di killers, secure di release of people wey dem kidnap, and bring back normal life to di area.

“Our administration no go tire to strengthen security infrastructure, equip our response personnel, and destroy criminal networks wey dey try to spoil di peace of dis nation.

“I dey urge our local communities to work with security forces by giving information wey fit help dem respond on time.”

Di gunmen reportedly enter Naridon Village around 11pm on Sunday, dey shoot people anyhow before dem set houses and shops on fire.

People wey survive say di attackers operate for many hours, wey leave serious destruction, families wey dey mourn, and plenty people wey don run from dia homes.