War between US and Iran cause petrol price to jump well well for Nigeria, and na Nigeria get di sharpest increase for di whole of Africa for first half of 2026.
Pump price shoot up by 39.5 percent, because di Middle East trouble scatter global crude oil supply—even though Nigeria dey try refine fuel inside di country, e still show say we dey feel outside market wahala.
Dis one dey inside di Half-Year Downstream Industry Report wey Major Energies Marketers Association of Nigeria release on Tuesday, wey cover January to June 2026.
Di report talk say di fight wey involve Israel, Iran, and US wey start on February 28, 2026, cause serious confusion for world oil market. Crude oil price pass $100 per barrel, and transportation cost for petroleum products shoot up worldwide.
E explain say because ships no fit pass through Strait of Hormuz again, dem comot from di normal route and begin go round Cape of Good Hope. Instead of di usual 18 days journey, e take almost 40 days now.
MEMAN tok say, “For first half of 2026, di serious tension for Middle East make people fear say fuel go shortage, and dat one add heavy risk wey push international crude price pass $100 per barrel.
“Dis price increase worse pass as di conflict block traffic for Strait of Hormuz, wey force oil tankers to change route go round Cape of Good Hope, and instead of 18 days journey, e stretch go almost 40 days.”
Di association talk say because Nigeria don remove subsidy for petrol, di global price wahala pass directly to customers, wey make Nigeria be di country wey suffer most for Africa.
E say, “For dis new system wey no get subsidy, Nigeria feel di price increase immediately for filling stations.
Data from di peak of di crisis show say Nigeria get 39.5 percent petrol price increase—wey be di sharpest for Africa, and e pass di increases for oda African countries like Egypt wey get 14.3 percent.”
Even with di big price increase, di report still talk say dis time na turning point for Nigeria downstream oil sector, because local refineries don begin to replace imported fuel faster than ever before.

























