Presido Bola Tinubu for Thursday talk say im administration go revive di refineries wey don pack up. But im warn say dia success go depend on wetin dem produce, not just sey dem dey do work like how e be for before.
Tinubu talk dis one when im receive di Executive President of Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers, Salimon Oladiti, and oda union members for Aso Rock Presidential Villa, Abuja, for Thursday.
Wen im dey address di union dia concern about how di revival of Nigeria state-owned refineries don dey delay for long, di President talk say, “Di refineries wey una mention go come back to work. We just dey build strong reset and structural reworking of di economy.
“Ordinary fire and smoke from refinery no mean sey e dey work, until e dey make profit and give di value wey dem build am for.”
Tinubu also tell vehicle and truck owners wey don convert to Compressed Natural Gas make dem pass di money wey dem dey save to di passengers, instead of dem alone dey chop di whole benefit.
Im talk say, “We go do more. We go encourage una, but tell una drivers make di saving reach di commuters too, because any benefit wey dey come from CNG dey enter di pocket of truck owners only. E no dey spread as fast as I want, but e suppose spread.”
Im connect both promises to di bigger fiscal reset wey im administration don dey do since 2023, and im tell di union sey di money wey dey available now for major road work na direct result of dat reform.
“I dey glad sey una don see di effect of being able to find money for long-term projects, di Lagos-Ibadan Road, Abuja-Kaduna, Abuja-Kano, Sokoto-Badagry and many oda road networks, all for our own good, for our economy and for di safety of our people,” im talk.
Wen im remember one tense meeting wey happen years ago for Akodo Resort for Lagos, di President talk sey im don tell di union di truth from di very beginning about di subsidy policy.
According to am, no threat of strike go force am to bring back petrol subsidy. Di Nigerian leader talk say, “Una don be very good partner of di government for progress.”





















