Donald Duke, di Peoples Redemption Party (PRP) presidential candidate, talk say e go reduce di price of petrol to about N300 per litre if dem elect am as president for 2027.
Duke, wey be former governor of Cross River state, yarn dis one during interview on Channels Television "Morning Brief" on Wednesday.
"I go try bring am to about N300," di former governor talk wen dem ask am wetin petrol price go be under im presidency.
"I don tell you, e sound like something wey no dey possible, but I don give you di arithmetic.
"Allocate 600,000 barrels, if na dat una dey consume everyday. Allocate dat one to yourself. Di oda one million, you can sell."
Duke tok come as oda presidential candidates dey continue to criticise President Bola Tinubu over di removal of petrol subsidy for 2023.





















