| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
FCTA don start free mass rabies vaccination for Abuja
Di Agriculture and Rural Development Secretariat (ARDS) talk say di exercise na to protect residents and animals from rabies.
FCTA don start free mass rabies vaccination for Abuja
FCTA say di exercise go cover all of Abuja

Di Federal Capital Territory Administration (FCTA) for Nigeria don mobilise veterinary and animal health officers for two-week free mass rabies vaccination exercise wey go cover di six Area Councils for di territory.

Di Agriculture and Rural Development Secretariat (ARDS) talk say di exercise na to protect residents and animals from rabies and make sure say communities across di FCT get good coverage.

Wen dem dey speak at di FCT Veterinary Clinic for Nyanya before di exercise start, di Director of Veterinary Services, Dr Dandam Karnak, tell di personnel make dem maintain high professional standards.

Karnak, wey represent di Mandate Secretary of ARDS, Comrade Abdullahi Suleiman Ango, praise di officials for dia commitment to public health intervention, and im talk say discipline and dedication go be key to make di exercise succeed.

Im talk say, "Di teams suppose go every corner of di six Area Councils to make sure say no community dey left out."

Karnak warn di officials against collecting money from pet owners, and im stress say di exercise dey fully funded by FCTA and must remain free.

Im talk say, "Di government dey pay all di cost for dis exercise to protect residents. So, no officer get permission to demand or accept payment from pet owners for di vaccination," and im add say any officer wey dem catch doin am go face disciplinary action.