| Pidgin
CULTURE
2 minit wey yu go read
Nigerian goment don approve new grid to stop electricity collapse
Tegbe talk say di goment dey prepare to start di procurement process for di projects, and e add say Nigerians go start to see di benefit in two to three years.
Nigerian goment don approve new grid to stop electricity collapse
Nigeria dey face light wahala

Nigerian goment don approve plan to build new Eastern-Western electricity grid as part of effort to solve Nigeria power grid wey dey collapse anyhow.


Di Minister of Power, Joseph Tegbe, talk dis one for di recent HBSAN energy conference for Lagos, where e explain plans to solve di long-time weakness for di country electricity transmission infrastructure.

Tegbe talk say di goment dey prepare to start di procurement process for di projects, and e add say Nigerians go start to see di benefit in two to three years.

E reveal say di goment don start technical audit across di whole country to understand di issues for di power sector and to know wetin dem suppose put first.

"We don cluster Nigeria into three energy zones. Di first one na di one wey dey demand 50 per cent. If you fix Lagos and you fix di Abuja corridors, you don solve more than half of di problem of Nigeria. Because you no fit do dat one alone based on operational efficiency, you also have to build out your grid.

Di President don approve say make we start di process of building out di grid: East and Western grid. We dey go through di procurement process, but na something you go see di benefit in two to three years," di Minister talk.

Di minister talk say di technical audit of electricity infrastructure na to find faults and know which facilities need urgent repair or replacement.

E talk say di exercise na to make sure say interventions address di real cause of di problems instead of directing money go wrong equipment.