| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Tinubu tell im opponents: “Na una create di poverty, hunger wey i dey try defeat”
Di President say im administration dey work to reverse di hardship wey e inherit from previous governments.
Tinubu tell im opponents: “Na una create di poverty, hunger wey i dey try defeat”
Presido Bola Tinubu with im wife

Na huge crowd show face as All Progressives Congress (APC) launch dia presidential campaign for next year election for Kaduna on Saturday.


While e dey address di party supporters, President Bola Tinubu accuse opposition politicians say dem dey try use hunger and poverty as campaign weapon before di elections, e allege say na dem cause di economic wahala wey dem wan use against im administration now.


Di President say im administration dey work to reverse di hardship wey e inherit from previous governments and lay foundation for better prosperity wey go last.


Tinubu dismiss criticism of im economic policies by opposition people and insist say those wey dey complain pass about hunger and poverty na dem cause di conditions wey dem wan use for political advantage now.


“I get argument. I hear my opponents dey talk about hunger, poverty. Who create am? Na dem. Na dem create di hunger. Na dem create di poverty. We dey try wipe am out,” e talk.


Im administration, e stress, don show say e commit to improve di welfare of Nigerians through economic reforms, regular payment of salaries and development initiatives wey APC governors dey do across di federation.


E talk say di APC dey offer Nigerians better way to economic recovery, growth and opportunities, instead of wetin e call di anger and failed policies of im political opponents.