FIFA don approve plan for one normalisation committee to run di Nigeria Football Federation (NFF) till May 2027.
For one letter to di NFF interim leadership on Thursday, FIFA talk say e go, together with CAF, appoint committee members "as soon as possible".
"Di period wey di normalisation committee go perform im functions go expire as soon as e don finish all im tasks, but no later than 31 May 2027," na wetin di letter talk.
Dem dey expect NFF to hold new elections before di committee tenure expire. None of di panel members go fit contest di positions wey dem go fill for di elections.
While dem dey wait to appoint di committee members, Emmanuel Ikpeme, di NFF acting general secretary, go continue to manage di affairs of di federation.
FIFA officials visit Nigeria for September to confam say government no dey influence di federation after most NFF executives resign for August.
Ibrahim Gusau, NFF president, and Mohammed Sanusi, di general secretary, both resign after pressure over disappointing performances by different national teams.

















