| Pidgin
WORLD
3 minit wey yu go read
Nigeria Police oga filming warning cause serious vex
Di African Action Congress also condemn di reported restriction, argue say Nigerians need di ability to document encounters with police officers.
Nigeria Police oga filming warning cause serious vex
Tunji Disu

Outrage dey grow ontop di right wey Nigerians get to record police officers wen dem dey do dia work for public, as human rights groups and di African Action Congress back di position of di Nigerian Bar Association against attempts to restrict di practice.


Di development follow afta recent clash of positions between di NBA President, Oyinkansola Badejo-Okusanya, and di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, ontop how far members of di public fit film police officers.


Di NBA president bin back citizens' right to record police officers wey dey do dia duties for public, while im call for clearer rules to protect officers from unnecessary intrusion into dia private lives.


Di position follow one March 17 judgment of di Federal High Court for Warri, Delta State, wey affirm Nigerians' constitutional right to record police officers while dem dey perform dia duties for public.

Justice Hyeladzira Nganjiwa, for di judgment for one suit wey one lawyer, Maxwell Uwaifo, file, also direct police officers to display dia names and force numbers during public operations.


Tokin on di controversy on Thursday, di Amnesty International Country Director, Isa Sanusi, say anything wey fit obstruct transparency for policing no fit be justified.
Im say, "Na di duty of di police to tell dia men to dey decent, to dey fair, to dey open, to dey transparent.


"So if dem dey transparent and decent, I no think say dem suppose mind whether people dey monitor dem or not."


Similarly, di General Secretary of di Committee for di Defence of Human Rights, Gerald Katchy, back di NBA's position, say recording police activities na important tool for accountability.


Katchy say, "For every other place and for developed nation, video recording whenever issues of security concern na part of di accountability we dey push for."Those wey no get anything to hide no get reason to dey fear make dem record dem."

Im say recordings fit help establish evidence for cases wey concern alleged police misconduct or resistance to lawful authority.


According to am, di police suppose instead encourage di use of body-worn cameras by officers to promote professionalism and accountability.


"Filming don help to establish evidence whenever issues of either misconduct or resistance to authority arise. So, e dey work both ways," im say.
Katchy argue say recording officers no suppose demoralise properly trained policemen, adding say officers wey follow dia training and professional rules no suppose get reason to fear make dem film dem.


"E no necessary, maybe, IGP saying say e dey demoralising. Di ones e go demoralise na those wey get ulterior motives," im say.


Di African Action Congress also condemn di reported restriction, argue say Nigerians need di ability to document encounters with police officers, particularly amid concerns over illegal checkpoints and criminals wey dey impersonate policemen.


Di party say, "From 'one-chance' robberies to illegal checkpoints to impersonators for police uniform, Nigerians need to record who stop dem, where, and wetin happen."