| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
31 companies wey win oil blocks fit pay reach N353bn as signature bonus to Nigeria
Dis estimate dey based on di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) new signature bonus wey now be between $3 million and $7 million per block.
31 companies wey win oil blocks fit pay reach N353bn as signature bonus to Nigeria
Di winners go pay signature bonus to di kontri

Nigeria fit make around N353 billion from signature bonuses wey successful bidders go pay for di 2025 oil block licensing round,

Even as di kontri don reduce di entry fees wey people must pay to encourage more investment for Nigeria upstream petroleum sector.

Dis estimate dey based on di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) new signature bonus wey now be between $3 million and $7 million per block, instead of di flat $10 million wey dem charge for di 2024 licensing round.

Di reduction, wey dey inside di Commission "Frequently Asked Questions (FAQs) on di NUPRC 2025 Licensing Round" wey dem release for December 2025, mean say dem don cut am between 30% and 70% from di old fee.

According to di document, "Di Nigerian government don kindly reduce di signature bonus to between $3 million and $7 million."

Di signature bonus na one-time payment wey no dey refund, wey successful oil companies dey pay to government as condition to get di right to develop oil block wey dem win.

If dem pay $7million signature bonus for each of di 37 blocks, dat one go total $259million, wey be around N353.4billion based on current exchange rate.

Di lower fees, according to experts, go make Nigeria licensing system more competitive, improve investor participation, and speed up exploration work, especially for frontier basins wey neva get plenty investment before.

Di 2025 licensing round get strong interest from investors, with 143 companies submitting 200 bids for 37 out of di 50 oil and gas blocks wey Federal Government offer.