| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Nigeria wan use 50,000 of dia diaspora doctors to boost healthcare
Dis initiative take centre stage over di weekend as Nigeria celebrate di 2026 National Diaspora Day (NDD) for Abuja.
Nigeria wan use 50,000 of dia diaspora doctors to boost healthcare
Nigeria dey face plenty healthcare challenges

Nigeria don talk say dem go use di Diaspora Health Impact Initiative (DHII) 2026 to help fix healthcare for Nigeria, by tapping from di plenty experience of over 50,000 Nigerian doctors and thousands more nurses, pharmacists, and public health specialists wey dey scatter all over di world.

Dis initiative take centre stage over di weekend as Nigeria celebrate di 2026 National Diaspora Day (NDD) for Abuja, with di theme "Harnessing Global Diaspora Expertise to Strengthen Local Health Systems for National Development" – wey mean "Using Global Diaspora Knowledge to Strengthen Local Health Systems for National Development."

For im keynote speech, Minister of State for Foreign Affairs, Ambassador Sola Enikanolaiye, talk say di DHII na flagship programme wey dem design to use di knowledge, experience, innovation, and professional networks of Nigerian healthcare workers wey dey abroad, to drive knowledge transfer, specialist medical outreach, capacity building, clinical mentorship, research collaboration, and health workforce development.

Dese interventions, im talk, don already dey improve healthcare access, enhance service quality, reduce health disparities, and advance universal health coverage across Nigeria.

Strong health systems, im add, dey important for economic growth, social stability, and national resilience. And by connecting global Nigerian medical expertise with local needs, di initiative dey help build a healthier and more prosperous future for di country.

Enikanolaiye stress say di diaspora remain one of Nigeria most strategic assets, wey serve as bridge for diplomacy, technology transfer, and global partnership – far beyond just remittances and investment.