| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Lagos goment sign new light deal wey go ginger electricity supply
One statement wey Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, release on Sunday yarn say dem sign di agreements as part of efforts to fix di gaps for power delivery.
Lagos goment sign new light deal wey go ginger electricity supply
Lagos goment say dem wan improve light / Others

Lagos State Goment for Nigeria don bring "no light, no pay" policy as dem sign three power purchase agreements to make electricity supply better and make sure say dem only pay for light wey dem really get for public facilities.

One statement wey Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, release on Sunday yarn say dem sign di agreements as part of efforts to fix di gaps for power delivery and make sure say steady light dey for di state.

"Today for Lagos House, Marina, I witness di signing of three power purchase agreements wey dem design to build on wetin dey ground and address wetin no dey work before," di governor tok.

Under di arrangement, different power companies don get assignment to support specific areas and infrastructure. Fenchurch Power go supply light to key water facilities for Adiyan and Iju, while Mainland Power go continue to dey give Ikeja, Oshodi, and Anthony light, and dem get plan to expand dia coverage. Viathan go continue to make sure say di key facilities for Island dey get steady electricity, and dem dey work to connect am better pass inside di distribution network.

"Fenchurch Power go support our major water facilities for Adiyan and Iju. Mainland Power go continue to serve Ikeja, Oshodi, and Anthony, with space to expand. Viathan go maintain stable power supply to key facilities for Island as we dey strengthen how e dey connect with di distribution network," e add.

Di governor still yarn say dem don review di agreements to reflect current realities for di power sector, and dem introduce new payment structure to make sure say accountability dey.

"We don update dis agreements make e reflect current market realities. We no go pay for light wey dem no deliver again. Payment now dey tied to actual, metered supply — e go help us reduce waste and manage cost well well," e tok.

According to di governor, di move go make power supply more reliable for public infrastructure, make sure say state resources dey used better, and support future expansion of electricity capacity.

"Dis one mean say public infrastructure go get more reliable power, state resources go dey used better, and we get clear way to increase capacity ova di next few years," di governor yarn.