| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Nigeria sojas don kill bandit leaders Anaruwa and Gomina, plus seven odas for Zamfara
Acting Deputy Director, Army Public Relations, 8 Division, Army/Sector 2 Operation Fansan Yamma, Lieutenant Colonel Olaniyi Osoba, confam di killings for one statement.
Nigeria sojas don kill bandit leaders Anaruwa and Gomina, plus seven odas for Zamfara
Nigeria dey try end banditry for northwest / Reuters

Di troops of Sector 2, Nigerian Army, don finish two bandit kingpins wey dem call Anaruwa and Gomina, togeda wit seven oda criminals, for operations wey dem carry out for di last three days for Zamfara and Katsina States.

Acting Deputy Director, Army Public Relations, 8 Division, Army/Sector 2 Operation Fansan Yamma, Lieutenant Colonel Olaniyi Osoba, confam di tins for one statement.

Im talk say for Zamfara State, troops wey dey di Forward Operating Base for Bagega carry out one dangerous operation for Anka Local Government Area, wey make dem kill seven terrorists, including two notorious leaders wey dem identify as Anaruwa and Gomina.
Anaruwa na di younger broda of Kachalla Idi Aiki, one notorious terrorist commander.

Lt. Col. Olaniyi still talk say for di first operation, di troops bin engage terrorists for Bagega–Anka Road for one serious gun battle.

“Di first clash make four armed terrorists wey dey two motorcycles run comot, leave dia bikes. But di terrorists gada demself again and attack Forward Operating Base Bagega.” im talk.
According to am, afta reinforcement from different combat teams and support from accurate airstrikes from di Air Component, di troops repel di attack as second wave of eight terrorists on four motorcycles bin come, wey make dem kill three terrorists.
“For di operation, troops recover two AK-47 rifles wit loaded magazines and seven motorcycles,” Olaniyi talk.

According to di statement, for one follow-up operation on 3 May 2026, troops see two more terrorists on motorcycles for di same area, and dem kill dem for where dem see dem.

Im talk say, “Di sad tin be say one soldier loose im life for di operation. Troops don strong dia position for Bagega, holding di area strong to stop any more wahala.”