| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
UK spoil my reputation, I no do anything wrong — Alison-Madueke
Di former petroleum minister, wey serve under former President Goodluck Jonathan between 2010 and 2015, talk say di restrictions wey dem put on her throughout di investigation affect her mind well well.
UK spoil my reputation, I no do anything wrong — Alison-Madueke
UK clurt say di former minister dey cleared / Reuters

Former Minister of Petroleum Resources, Diezani Alison-Madueke, don accuse British authorities say dem spoil her reputation through corruption case wey last more than ten years and finally end with dem find her not guilty.

Alison-Madueke talk dis one during interview with BBC, days after jury for Southwark Crown Court for London clear her and two oda people wey dey with her for case from multiple bribery charges wey dem face.

Di former minister don face five charges of receiving bribes and conspiracy to commit bribery afta 13-year investigation wey di United Kingdom National Crime Agency (NCA) do.

As e reach her to react to di verdict, Alison-Madueke describe di long investigation and prosecution as one of di hardest times of her life, as im talk say e cause serious emotional, professional, and personal wahala.
“Dem no allow me travel. Dem no allow me work. Dem spoil my reputation and my integrity,” she tell BBC.

Di former petroleum minister, wey serve under former President Goodluck Jonathan between 2010 and 2015, talk say di restrictions wey dem put on her throughout di investigation affect her mind well well.
“When dem take your freedom away from you, e get deep impact on you psychologically,” she talk.

“I know sey I never do anything bad and I never do any of di terrible tins wey dem dey accuse me of doing.”
Dem first arrest Alison-Madueke for London for 2015 but dem no formally charge her until 2023.
British prosecutors don allege sey she receive luxury benefits from oil businessmen wey get big government contracts for Nigeria. Di alleged benefits include access to expensive houses, cars wey get drivers, and oda expensive gifts.
But afta dem hear evidence for di case, di jury return not guilty verdict for all di charges against di former minister.