Nigeria big fibre project wey go cover 90,000 kilometres don secure $200 million loan from African Development Bank Group (AfDB) to help di rollout fast fast across di whole country.
AfDB announce di loan approval for di weekend, and na part of effort to support ‘Project Bridge’ (wey dem dey call D-VIBE), to grow digital skills and create jobs for di country.
Dis project go help increase Naija fibre backbone from about 30,000 kilometres to nearly 120,000 kilometres by di end of 2027.
Di project wey World Bank sef dey support, go connect all di 774 local government areas across Nigeria to high-speed broadband.
According to AfDB, di $200 million loan na part of $800 million sovereign financing package for di project, plus $500 million from World Bank and $100 million from European Bank for Reconstruction and Development (EBRD).
“Total money for di project na about $2 billion, and e include EU grant of €22 million, $2.6 million from MCDF for project preparation, and at least $1.2 billion investment from private sector,” di bank talk.
While commenting on di matter, di Director General of African Development Bank Group Nigeria Office, Abdul Kamara, talk say: “Nigeria get di talent, di market, and di ambition; wetin di country lack na di backbone infrastructure to connect dat potential to opportunity.
“D-VIBE go change dat. From north to south, from farms to factories to classrooms, dis investment go make high-speed connectivity real for every Nigerian community and give young people di tools to build dia future digitally.”
Di project go help create up to 2.8 million jobs over its lifetime and increase national broadband penetration from 45 percent to about 70 percent by 2030.
E go also establish cross-border fibre links with neighbouring countries like Benin, Cameroon, Niger, and Chad.






