| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Nigeria set aside N73.4 Billion for Tuberculosis drugs, as WHO dey call for more funding
Dis one come as di World Health Organisation (WHO) dey urge di government to increase money well well to fight TB.
Nigeria set aside N73.4 Billion for Tuberculosis drugs, as WHO dey call for more funding
WHO want make Nigeria add money to foght TB / Getty Images
8 hours ago

Nigeria don set aside about N73.4 billion to buy tuberculosis (TB) drugs and oda tins wey dem need, so dat TB medications no go finish for di country.

Dis one come as di World Health Organisation (WHO) dey urge di government to increase di money wey dem dey spend from inside di country and make di community join hand well well, so dat di progress wey dem don make for di fight against TB for Nigeria no go stop.

Also, di government dey spread di national rollout of TB near-point-of-care technology, wey be Pluslife Mini Dock diagnostic equipment, across di whole country. Dis one go bring molecular-grade testing go di most far villages and make sure say no Nigerian wey dey for remote area go suffer because of where dem dey.

Dr Charles Nzelu, wey be Director of Public Health for Federal Ministry of Health and Social Welfare, announce dis tins yestarde for Pre-World TB Day briefing wey dem hold for Abuja. Im talk say, since last year wen major global funders for AIDS, Tuberculosis and Malaria (ATM) announce say dem go withdraw funding — wey spoil ATM management for all ova di world — Nigeria don announce say dem go provide $200 million (state-wide money) to fill di gap wey U.S. government funding cut create.

Nzelu talk say di government dey take proactive steps to make sure say TB drugs and commodities no go finish for di country. Im explain say der be some medications wey di global fund no dey buy for Nigeria, and according to di way tins dey go, "di government dey forecast say for some months time, we go begin see some of dese drugs finish for stock."