Nigeria Dangote refinery don increase export of petroleum and urea go African countries wey supply don disturb because of Iran war, na the owner Aliko Dangote talk on Monday.
Dangote talk say refinery, wey dey operate for e maximum capacity of 650,000 barrels a day, don help cushion full impact of the crisis for Nigeria and across the continent.
"Wet I fit do na to assure Nigerians... and most of West Africa, Central Africa, and East Africa, we get the capacity to supply them," Dangote talk as e dey do tour for the refinery wey dey the edge of commercial capital Lagos.
E talk say the facility don ship about 17 cargoes of petrol go other African countries and export of urea fertilisa don also rise recently as buyers dey find alternative sources of supply.
Refinery increases supply to African countries
"For the last couple of days, we don dey look mostly to African countries, which we no dey do before," e talk, as e dey refer to the fertilisa shipments, but e no give figures.
The refinery get capacity to produce up to 3 million metric tonnes of urea every year, most of which dem usually export go the United States and South America, officials talk.
Industry figures show say fuel price for oil-producing Nigeria don reach record-high levels, as the maximum output from Dangote refinery never fit offset the impact of high crude prices.
Dangote talk say the refinery dey hope to get more crude cargoes wey dem go price in local currency to help reduce fuel costs.
Two trade sources and one refinery official tell Reuters last week say state oil firm Nigerian National Petroleum Company dey allocate seven May 2026 cargoes for Dangote refinery, up from five in previous months.








