Di Super Falcons of Nigeria don fail to qualify for 2027 Women’s World Cup.
Di team lose 2-1 to South Africa for dia continental playoff on Thursday at Stade Moulay Rachid for Casablanca, Morocco.
Falcons’ World Cup hope bin reduce to playoff afta dem lose 1-0 to Cameroon for di quarter-final of 2026 Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON). Only di teams wey reach WAFCON semi-final get di four automatic tickets for African countries.
Di four teams wey lose for quarter-finals get second chance and longer road to grab one of di three non-automatic World Cup tickets through inter-confederational playoffs.
Falcons bin draw against Bayana Bayana for one spot for di inter-confederational playoffs, but di team still no fit use di chance.
Di South Africans score two goals early for second half through Thembi Kgatlana and Refiloe Jane. Before Christy Ucheibe score one back for Falcons late for di game as dem dey struggle but no fit force di match go extra time.
Nigeria go miss di women’s World Cup for di first time since e start for 1991.
Banyana Banyana don move go di first phase of interconfederational playoffs for di World Cup wey go hold for Brazil next year June.





















