At least 200 pipo dey feared dead afta Nigeria military jets bomb one village market wey dem dey pursue Islamist militants for northeast of di country for Saturday night, according to one councillor for di area and residents wey talk for Sunday.
Di Nigerian Air Force, wey hear reports say civilians die, talk for statement say dem don activate dia Civilian Harm Accident and Investigation Cell "to go di place immediately on a fact-finding mission based on di allegation."
Before dis one, di Air Force don talk say dem kill Boko Haram militants for Jilli area for Borno state.
Di government of neighboring Yobe state later talk for statement say one airstrike wey dem carry out for di area happen near one market wey shoppers and vendors don gather.
"Some pipo from Geidam LGA (local government area) wey border Gubio LGA for Borno state, wey go Jilli weekly market, na dem dey affected," Brigadier General Dahiru Abdulsalam, military adviser to Yobe state government, talk so.








