Muhammadu Sa’ad Abubakar, wey be Sultan of Sokoto and leader of Nigerian Muslims, don tell Christians and Muslims for Nigeria make dem stop dey insult each oda, say religious tolerance dey important sotay we fit live for peace.
Di Sultan talk dis one for Abuja on Tuesday, for di International Conference on National Security for Socio-economic Development, wey Jama’atu Izalatil Bidiah wa Iqamatis Sunnah (JIBWIS Nigeria) arrange, wit help from Muslim World League of Saudi Arabia.
“We must be honest wit ourself sey Christians fit stop to dey insult Muslims. Muslims fit stop to dey insult Christians. And dat be how we go live for peace,” im talk.
Di Sultan talk sey Muslims and Christians no suppose tink sey dem betta pass each oda, im talk sey all people dey equal before God.
“We no dey here to talk sey we betta pass anybody. We no betta pass anybody. Im [God] be di One wey create all of us. Im go decide who betta. And Im know how to do am. So I no dey here to talk sey I betta pass anybody,” im talk.
Im tell Nigerians make dem revive di culture of dey care for dia neighbors, no matter dia religion or tribe.
“Allah create your neighbor for you. Who ever be your neighbor, you know wetin you suppose do for your neighbor,” im talk.
Di traditional ruler show concern about di way social media dey spoil, wey some Nigerians dey lie and talk bad about dia leaders.
WORLD
2 minit wey yu go read
Sultan: Nigerian Christians, Muslims, no suppose dey insult each oda
Di Sultan talk sey Muslims and Christians no suppose tink sey dem betta pass each oda, im talk sey all people dey equal before God.

Explore




















