| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
143 companies dey fight for 50 oil and gas blocks for Nigeria
Di statement tok say: "Di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) don invite qualified companies to di highly anticipated commercial Bid Conference.
143 companies dey fight for 50 oil and gas blocks for Nigeria
NUPRC say dem don make invites on top di mata

Di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) don announce yesterday say 143 companies dey race to get di 50 oil and gas blocks wey dey available for di 2025 bid round.

Di Commission tok dis one for press statement wey dia Head of Media and Corporate Communications, Eniola Akinkuotu, sign yesterday.

"Because of dis, 143 companies submit 200 bids. Dis 143 companies go take part for di commercial bid conference wey go hold on July 21, 2026," di statement tok.

E remember say di registration and submission for prequalification evaluation close on February 27, 2026, while di prequalification stage finish on March 16, 2026.

According to am, total of 286 companies make submissions for prequalification, and out of dat one, 196 be prequalified to take part for di technical and commercial bid phase.

Di statement tok say: "Di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) don invite qualified companies to di highly anticipated commercial Bid Conference wey go hold for July 21, 2026."

"Dis companies wey pass through di transparent and rigorous process don receive notification and dem suppose physically attend di Commercial Bid Conference wey go take place for Conference Center, Transcorp Hilton Hotel, Abuja."

"Di blocks wey dey available na 50 oil and gas blocks across different terrains. Dem include: Niger Delta Onshore (16), Niger Delta Shallow Water (18), Niger Delta Deep Offshore (1), Benin Basin Onshore (3), Anambra Basin Onshore (4), Chad Basin Onshore (4) and Benue Trough (4)."

"According to di guidelines, di elements of bid parameters include: di signature bonus, di work programme commitment and commitment to performance security wey go culminate for weighted technical and commercial score wey go determine di winning bid."

Di 2025 Licensing Round first announce on November 11, 2025 and dem advertise am well well according to di Petroleum Industry Act, 2021.

"Di bid portal launch on December 1, 2025 for Registration and a Pre-Bid Conference follow on January 14, 2026 for Eko Hotels and Suites, Lagos."

"Di Pre-Bid Conference serve as opportunity to educate registered bidders and oda interested members of di public about di guidelines of di exercise."