| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Meningitis don kill 33 pikin for Sokoto wey dey northern Nigeria.
According to di commissioner, dem don record 256 suspected cases across eight local government areas for di state since dis disease show face again about one month ago.
Meningitis don kill 33 pikin for Sokoto wey dey northern Nigeria.
33 pikin don die already / Reuters

Sokoto State Government don confam say 33 children don die afta cerebrospinal meningitis outbreak for some part of di state.

Di Commissioner for Health, Dr. Faruk Abubakar, talk dis one on Wednesday during one meeting wit district heads about safety and antimicrobial resistance of mass administration of azithromycin for children (SARMAAN) and maternal and neonatal tetanus elimination (MNTE).

Di meeting na di state Primary Healthcare Development Agency arrange, wit help from Sightsavers and Chigari Foundation.

According to di commissioner, dem don record 256 suspected cases across eight local government areas for di state since dis disease show face again about one month ago.
Daily Trust bin report say di pipo for Kurawa village for Sabon Birni LGA don raise alarm say meningitis dey suspect, and e dey affect pikin and teenagers mostly.

Source from di village health centre also tell our reporter say di matter don worsen, and almost two to three pipo dey die evriday, mostly people wey be between 2 and 20 years old.
Dem note say many of di victims die before dem even fit diagnose di sickness well-well, and dem later advise di pipo make dem no sleep inside room wey no get air because of hot weather.

Di pipo describe symptoms like: person go dey faint, get serious neck pain, dey vomit, get run belle, high fever, and for some cases, foam dey comot from mouth — all dis one dey match meningitis signs.

During di Wednesday meeting, Dr. Abubakar confam di outbreak, say Sabon Birni get highest cases wit 63, follow by Wamakko (60), Shagari (51), Tambuwal (33), and Dange Shuni (26). Kebbe get 16 cases, while Bodinga, Gada, and Kware get two, one, and two cases each.

Di health commissioner note say most of di death happen inside di communities before dem carry di sick pipo go hospital.