Nigerian High Commission for South Africa don appeal make everybody exercise patience and find peaceful way to settle matter after comments wey Vincent Magwenya, spokesman to South African President Cyril Ramaphosa, make about Nigeria High Commissioner, Mr Femi Fani-Kayode.
The Nigerian Mission talk for dia verified X account say dem want make Nigeria and South Africa continue to enjoy friendly relationship.
The disagreement start after person interrupt South African Presidency YouTube live broadcast when Fani-Kayode suppose present im letters of credence to President Ramaphosa for Tshwane.
Dem later restore the live broadcast while Ramaphosa dey address the ambassadors.
After that one, Magwenya accuse Fani-Kayode say e dey lie about Ramaphosa involvement for the matter wey concern im diplomatic credentials.
The Nigerian Mission explain say Fani-Kayode, wey be among the last diplomats to present their credentials, complain say dem deliberately remove im speech from the broadcast.
According to the Mission, Fani-Kayode carry the matter go meet Ramaphosa, and the South African President apologise to am and assure am say everything dey alright.
The Mission say dem suppose handle the disagreement through diplomatic channels, and e advise Magwenya to exercise restraint.
The Mission describe Magwenya behaviour as provocative and something wey no follow diplomatic rules.
Dem explain say the statement wey dem publish na to reject wetin dem describe as Magwenya attempt to paint Fani-Kayode as person wey no dey tell truth and damage Nigeria image.
The Mission talk say:
“To us, this matter don close, but if you wan carry am further, you fit do so, and we dey ready for anything wey follow. Person wey get sense no need plenty warning.”
The Nigerian Mission also praise President Ramaphosa for stepping into the matter to settle am.






















