| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
VP Shettima say time don reach for Nigeria, Africa to take beta place for global trade
Shettima talk dis one for weekend visit for Cotonou, Republic of Benin, wen im lead some Nigerian state governors f
VP Shettima say time don reach for Nigeria, Africa to take beta place for global trade
Kashim Shettima

Nigeria Vice President Kashim Shettima talk say time don reach for Nigeria and di rest of Africa to take dia rightful place for control of global resources and trade, by using di natural blessings wey di continent get.

Im talk say dis one fit only happen if di nations for Africa gada demself and use di full potential of di resources wey dem get.

Im talk dis one for weekend visit for Cotonou, Republic of Benin, wen im lead some Nigerian state governors for official tour and assessment of di Glo-Djigbé Industrial Zone (GDIZ) for dat neighbouring country.

Im assure say as long as Bola Tinubu remain President, no region go dey left behind for dis new industrialization drive.

According to Shettima, dis administration, together with di state governments, don resolve to do everything possible to develop Nigeria well-well.

Im happy with di efforts of di Beninese government to start mass production and export of di resources wey dem get.

Im talk say out of di $370 billion worth of global cotton, Africa only benefit from about one percent of dat amount, and im maintain say because di presidency don resolve to change di matter, reviving Nigeria textile value chain fit generate millions of jobs, expand non-oil exports, and boost economic activity across di country.

Shettima, wey be impressed with wetin im see after im go round di cotton, textile, cashew, and soyabean oil production units of di big industrial zone, assure say Nigeria go replicate some of di things wey im see for Cotonou.

“We dey set up eight agro industrial zones for eight states for our country, and to tell you clearly say dis na African success story wey get whole chain of value addition for cotton, cashew, and soya bean value chains.”

“Make una rest assured say we don learn plenty lessons from dis visit and we go replicate plenty of dat one for Nigeria, as we dey focused on becoming one of di industrialised nations for di world.”

Di Vice President and governors bin get briefing about di zone structure, production capacity, and investment potential from Benin Minister of Tourism and Foreign Trade, wey also dey handle Industry and Promotion of Private Investment, Olushegun Adjadi Bakari.