Di security chiefs for Nigeriao don comot to go stay for Maiduguri, di capital of Borno State, to take over di security mata. Dis one come after di suicide bombers wey dem coordinate attack on Monday night, wey kill 23 pipo and injure 108 oda pipo.
President Bola Tinubu, wey on Tuesday give order for dem to move go there sharp sharp, call di attacks "desperate and frantic attempts" by terrorist elements wey dey under heavy pressure from security forces.
Three suicide bombers detonate bomb almost di same time around 7:02 p.m. for Maiduguri Monday Market, di Post Office Flyover side, and di security post for di entrance of University of Maiduguri Teaching Hospital.
For statement wey im post for im official X handle on Tuesday, di President mourn for di pipo wey kpai for di attacks and thank di troops for how dem repel di coordinated assaults for military positions for di state.
"I dey mourn for those wey lost dia life, I dey sympathize with di injured ones and I dey stand with di pipo of Borno for dis hard time," Tinubu tok.
Di President talk say di attacks na di final desperate acts by criminals wey dey try make fear catch pipo, as dem dey face plenty pressure from security agencies.
"I wan make e clear well well say dis kind terror acts na di final desperate and frantic attempts by criminals and terrorist elements wey dey try make fear spread, because our brave armed forces and security agencies wey dey operate for different places dey put dem under pressure evritime," im tok.
Tinubu come reveal say im don give order to security make dem relocate go Maiduguri take charge of di situation.
POLITICS
2 minit wey yu go read
Borno blast: Nigeria service chiefs don land for Maiduguri
President Bola Tinubu, wey on Tuesday give order for all service chiefs to move go there sharp sharp, call di attacks "desperate and frantic attempts" by terrorist elements.

Explore














