| Pidgin
POLITICS
1 minit wey yu go read
President Tinubu don sign Bill to protect displaced pipo for Nigeria
Di main work of dis law na to find wetin dey make pipo run comot from dia house for Nigeria, and make sure e no dey happen again.
President Tinubu don sign Bill to protect displaced pipo for Nigeria
Kata Kta for some parts don make IDPs plenty for Nigeria / AP
7 hours ago

President Bola Ahmed Tinubu don put im hand for di law wey go protect pipo wey don run comot from dia house because of wahala for inside Nigeria.

Dis one na di African Union Convention wey dem dey call Kampala Convention.

Dis new law wey Deputy Speaker of House of Representatives, Benjamin Kalu, bring, na to make sure say di African Union Convention wey dey protect pipo wey don run comot from dia house because of wahala, fit work for inside Nigeria.

Oda pipo wey join bring di law na Jonathan Gaza Gbefwi, Khadijat Bukar Ibrahim, Blessing Onuh, Nasiru Shehu, Felix Uche Nwaeke, and Steve Fatoba.

Di main work of dis law na to find wetin dey make pipo run comot from dia house for Nigeria, and make sure e no dey happen again. E go follow wetin di Nigerian Constitution of 1999 talk, and oda laws wey Nigeria don sign for international level.