| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Nigerian goment don bring back 13 of dia pipo wey dem traffick go Ghana
Di group wey dem rescue get 11 adults and two small pikin, one be four weeks old and di oda one be 16 months.
Nigerian goment don bring back 13 of dia pipo wey dem traffick go Ghana
Mrs Abike Dabiri na NIDCOM oga for Nigeria / User Upload
9 hours ago

Di Nigerians in Diaspora Commission, wey dem call NiDCOM, don bring back 13 Nigerians wey dem rescue from human traffickers for Ghana.

For statement wey dem sign by di Head of Media, Public Relations, and Protocols Unit, Mr. Abdur Rahman Balogun, di Chairman and CEO of NiDCOM, Hon. Abike Dabiri Erewa, don praise di Nigerian High Commission for Ghana sake of dem help make di victims return safe.

Dabiri Erewa still thank di First Lady, Senator Oluremi Tinubu, because she dey always support with transportation and oda help during rescue work.

Di statement tok say NAPTIP don do profiling as part of di normal process to help dem settle back, while NiDCOM provide logistics support to make sure di returnees reach dia various states safe.

Di returnees, dem receive dem on behalf of di NiDCOM chairman by di Head of Operations for Lagos, Mr. Dele Ogunkanbi.

Dabiri Erewa still talk about di worry wey dey for di wahala of irregular migration, and she warn young Nigerians make dem no gree follow fake job offers and travel arrangements wey dem dey advertise for abroad.

Di group wey dem rescue get 11 adults and two small pikin, one be four weeks old and di oda one be 16 months. Some of di women and pikin dem dey receive medical care and mental health support because doctor don find serious health issues for dem.