| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
Nigeria don climb pass four nations for Africa investment ranking
Nigeria pass Rwanda, Tanzania, Kenya and Namibia for di 2026 Bloomberg Economics Investment Risk-O-Meter, wey dey check how 19 African economies dey good for investment.
Nigeria don climb pass four nations for Africa investment ranking
Nigeria Presido Bola Tinubu

Nigeria don show as di biggest climber for Africa latest investment risk ranking, as e rise four places go eighth position as economic reforms wey President Bola Tinubu do don improve how di country dey attractive to investors, na so one new report by Bloomberg talk.

Nigeria pass Rwanda, Tanzania, Kenya and Namibia for di 2026 Bloomberg Economics Investment Risk-O-Meter, wey dey check how 19 African economies dey good for investment.

Bloomberg, for di report wey dem release on Monday, talk say Nigeria improvement come from beta performance for three out of five indicators wey dem use for di assessment: economic strength, fiscal strength and external vulnerability.

"Nigeria na di biggest climber for one ranking of Africa most investable markets, and President Bola Tinubu economic reforms na im push am, according to wetin di latest edition of An Investor's Guide to Africa find.

"Di continent biggest oil producer and refiner rise four places go eighth for di 2026 Bloomberg Economics Investment Risk-O-Meter, as e pass Rwanda, Tanzania, Kenya and Namibia as e improve for three out of five metrics wey di gauge check: economic strength, fiscal strength and external vulnerability," na so Bloomberg report am.

Dis development put Nigeria among di biggest gainers for di continent, even though concern still dey about di country high public debt, cost of living, inflation, infrastructure deficit and foreign exchange pressure.

Mauritius show as di most investable African market for di latest ranking, while Botswana fall two places. South Africa, wey top di ranking for di previous edition, also drop one place following weaker economic growth outlook.

Nigeria improved position come more than three years after Tinubu enter office and start plenty major economic reforms wey aim to restructure di country fiscal and monetary environment.