| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
IMF don warn Nigeria say make dem no bring back fuel subsidy again
Di Director of di IMF Fiscal Affairs Department, Rodrigo Valdés, give di warning on Wednesday during di IMF and World Bank Group Annual Meetings for Bangkok, Thailand.
IMF don warn Nigeria say make dem no bring back fuel subsidy again
Nigeria comot fuel subsidy for 2023

Di International Monetary Fund don warn Nigeria say make dem no bring back blanket petrol subsidy as political pressure dey mount ahead of elections, saying di Federal Government suppose instead put money for vulnerable households wey dey struggle with rising energy costs.

Di Director of di IMF Fiscal Affairs Department, Rodrigo Valdés, give di warning on Wednesday during di IMF and World Bank Group Annual Meetings for Bangkok, Thailand.

Wen dem ask am question about growing demands to bring back petrol subsidy for Nigeria ahead of elections, Valdés talk say rising fuel prices fit cause political wahala for governments but e warn say to subsidise consumption for everybody go cost public finances plenty money.

E talk say, "At di end of di day, e dey very tempting politically because di political effect of di price of oil, of fuels, of gasoline, of diesel no be small thing.

"But you have to explain say dis na global shock, first. Second, say e dey very, very expensive for di country not to recognise dat shock.

"And third, e much better to use some of dat money wey dem go spend on subsidies carry am go give more vulnerable people."

Di IMF official maintain say governments fit get better results if dem direct limited public resources towards households wey dey face di greatest financial hardship instead of subsidising petrol for all consumers, whether dem get money or not.

E talk say transportation subsidies na possible alternative to broad fuel price interventions.