| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Nigeria passport ranking don fall to 181, visa-free access sef shrink
According to data wey dem publish on IziVisa.com, people wey hold Nigerian passport fit travel to only 24 countries without visa.
Nigeria passport ranking don fall to 181, visa-free access sef shrink
Nigeria slip from 90 position from before

Nigeria passport don fall again from 90th position for July 2026 to 181st out of 196 countries for di latest IziVisa Passport Ranking Index, and e show say di number of places Nigerian passport holders fit enter without visa before don reduce well well.

According to data wey dem publish on IziVisa.com, people wey hold Nigerian passport fit travel to 24 countries without visa, collect visa on arrival for 16 countries, and enter 43 countries through electronic visa.

Di latest ranking show say e drop well well from di 90th position wey Nigeria bin dey for July 2026, when him passport bin dey give visa-free access to 44 places.

Di fall for di visa-free score from 44 to 24 places show di difference between di two rankings wey dem report and di reduced number of countries Nigerians fit visit without visa approval before.

For one statement on him website, IziVisa explain say dem dey rank passports according to di number of places wey di people wey hold am fit enter without getting visa before.

Di index dey consider different kinds of travel access, including visa-free entry, visa on arrival and electronic visa, wey dey determine how far passport holders fit move internationally.

Di United Arab Emirates dey lead di 2026 IziVisa ranking, with him passport dey provide access to 185 out of 198 places wey dem document through visa-free entry, visa on arrival or electronic visa.

Switzerland dey second position, with access to 120 places without visa, 26 places wey dey offer visa on arrival and 37 wey person fit enter through electronic visa.
Oda countries wey show face well well for di ranking include Luxembourg, Malta, Denmark, Spain and Finland.