| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
8 Nigerian sojas die as dia patrol motor hit landmine
Di incident happen on Saturday for Kinuba village, about 25 kilometres from Gamboru, near Naija border with Cameroon.
8 Nigerian sojas die as dia patrol motor hit landmine
Nigerian Army

At least eight sojas don die after dia patrol motor run over landmine wey Islamic State West Africa Province (ISWAP) fighters allegedly plant for Borno state.

Di incident happen on Saturday for Kinuba village, about 25 kilometres from Gamboru, near Naija border with Cameroon.

Report talk say di sojas been dey inspect anti-jihadist militia members wey dey clear bush along highway outside Gamboru when dia motor hit di explosive.

One military officer for di region talk say all eight sojas wey dey inside di motor die for di explosion.

Ibrahim Liman, one member of di anti-jihadist militia wey dey help di military, also confirm di death toll to AFP.
Liman talk say dem plant di explosive on dusty road and dem detonate am from far with detonating cord.

He add say one militia member wey dey supervise di clearing operation get shrapnel injuries.

Di attack happen on di same day Waidi Shaibu, chief of army staff (COAS), visit Maiduguri, di Borno state capital, after one assault on military base wey kill 15 sojas and five anti-jihadist militia members some days before.

ISWAP, wey be affiliate of Islamic State group, dey active for di area, where terrorists dey frequently use roadside bush as cover to ambush troops and motorists.