154 students of di Government Science Secondary School, Batagarawa for Katsina state, bin suffer hospitalisation after dia body react badly to drugs.
For one statement on Wednesday, Abubakar Sadiq Aliyu, di Katsina police command public relations officer (PPRO), talk say di incident happen on Monday afta di students reportedly develop symptoms of "adverse drug reaction" following di administration of praziquantel tablets.
Dem reportedly give di tablets by di school authorities to treat bilharzia. Di disease also known as schistosomiasis wey parasitic worms dey cause and e dey spread through contact with freshwater wey di parasites don contaminate, including rivers, ponds, lakes and streams.
He talk say dem carry di affected students go hospital for treatment and dem discharge dem, no casualties or loss of life recorded.
Di command talk say di remaining 25 students, wey dem earlier keep for hospital for further medical care, dem also treat and discharge dem.
He add say all di affected students dey good health and dem don reunite with dia families and schoolmates.
























