| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Turkiye and US join Nigeria to mourn di NAF plane victims
President Bola Ahmed Tinubu bin declare three-day national mourning for di victims on Monday and order say make dem fly flags at half-mast.
Turkiye and US join Nigeria to mourn di NAF plane victims
Search for bodies dey continue

Di United States and Türkiye don join Nigeria to mourn di 25 victims of Monday Nigerian Air Force (NAF) plane crash wey happen for Ondo, as di Air Force release dia names and confam say no survivor dey.

President Bola Ahmed Tinubu bin don declare three-day national mourning for di victims on Monday and order say make dem fly flags at half-mast for di whole country as mark of respect for di people wey die.

Di United States Mission for Nigeria, Republic of Türkiye and Di Displaced Children Foundation Canada send dia condolences to di families, friends and colleagues of di people wey die.

Di U.S. Mission carry dia condolences put for one post wey dem share on dia official X account yesterday, as dem join di plenty tributes to di victims of di crash.

"Di U.S. Mission for Nigeria dey send our deepest condolences to di families, friends, and colleagues of those wey lost dia lives for yesterday Nigerian Air Force crash," di mission talk.
Dem add say di condolences follow di long-time security relationship between Nigeria and di United States.

"We stand with di people of Nigeria and we remain committed to our strong security partnership," di mission talk.

Just like dat, di Republic of Türkiye express deep sadness over di loss of lives for di military aircraft crash.

Di Turkish Ministry of Foreign Affairs, for one statement wey dem issue yesterday through di Turkish Embassy for Abuja, extend condolences to di families of di victims and di people of Nigeria.